All my guys nah ballers

Make I quickly gist una
About my guys wey
dey burst brain like ajaguna,
My guys no dey chill,
Them be baba for their hoods
Make you una hear ham
Book nah their livelihood.
For their faculties
Them don become booklords
When girls see them
Them dey call them their lords.

My guys say make una prostrate
Una dey hesitate
E be like say una no dey hear word
Una no dey look face?
Where my guys dey ball
Who fit show face,
Abi una wan dey denge denge
Or una wan dey pose?
My guys go slam dunk una balls
And commot una for post
Make I no deceive una
Them be bosses.

When them dey tensed
Them dey reason with sense.
My guys no dey rehearse
E plenty like grains,
When questions jam them
Them dey use their brains.

Abeg no con no angry them
Make una better behave
I just say make I warn una
On their behalf.
The way my guys dey crunch book
Con be like buns
Day by day,
nah night candle them dey burn.

The eulogist

Leave a comment

Design a site like this with WordPress.com
Get started